On Air Now

You & Yaw

9:00am - 11:00am

Ministerial List: Presido Tinubu Don Send The Names Of Nyesom Wike, El Rufai, and Other Give Senate

60 days after Presido Bola Tinubu siddon for chair as President, him don finally send the list of the names of pipu wey eim want to work with am as ministers give the senate house of we obodo Nigeria.

The Chief of Staff to the President, Femi Gbajabiamila wey before-before Speaker of the House of the Representatives, na eim help presido send the list on Thursday afternoon. And the Senate President Godswill Akpabio by 01:19 pm.

Oga Akpabio come read the ministerial list wey get the name of 28 pipu inside as the first list of names wey presido dey send.  

Oya see the full list:

Abubakar Momoh, Yusuf Maitama Tukur, Ahmad Dangiwa, Hannatu Musawa, Uche Nnaji, Betta Edu, Diris Anite Uzoka, David Umahi, Ezenwo, Abubakar Badaru, Nasir El Rufai Ekerikpe Ekpo, Nkiru Onyejiocha, Olubunmi Ojo, Stella Okotete, Uju Kennedy Ohaneye, Bello Muhammad Goronyo, Dele Alake, Lateef Fagbemi, Mohammad Idris, Olawale Edun, Waheed Adebanwo, Suleman Ibrahim, Ali Pate, Joseph Usev, Abubakar Kyari, John Enoh, Sani Abubakar Danladi.

No, forget say constitution tok say presido get 60 days to take form eim cabinet.


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C