On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Minister Dey Face Serious Wahala Ova NYSC Service

Di Human Rights Writers Association of Nigeria (HURIWA) don accuse di Minister of Art, Culture, and Creative Economy, Hannatu Musa Musawa, on top say she dey serve as minister as she dey do di compulsory one-year National Youth Service Corps (NYSC) scheme.

On Thursday, di association bin release one statement wey dem dey accuse di minister say she abandon her NYSC service for Ebonyi state.

HURIWA tok say Musawa later gree to complete her service and dem mobilize he dis year for NYSC.

Allegedly dem postt am go one law firm for Abuja before dem be appoint am as minister.

Di group want make NYSC to make Musawa to choose between her national youth service and her ministerial appointment.   

How una see di mata?
#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C