On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Thread: Meta's Twitter Competitor Don Get Ten Million Users - Zuckerberg.

Meta CEO Mark Zuckerberg tok say ten million pipo don sign for dis new threads app, for di first seven hours when dem just start.

Zuckerberg tok say the app na "friendly" competitor with Twitter, wey Elon Musk buy for October.

For Threads, pipo fit post up to 500 characters, and im bin get many qualities wey be like Twitter.

Mr Zuckerberg tok before say making the program "friendly will finally be the way to success".

Dem ask Zuckerberg whether di app go "big pass twitter" Zuckerberg tok say "e go take time", but im  hope say dey app go get 1billion pipo on am.

Twitter don get opportunity to do am but dem never succeed. Na eim make Zuckerberg think say dem go win.

Threads don dey available now to download for over 100 countries plus UK, but dem never dey EU because of the problem of regulation.

How u see di mata?
#chookmouth. 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C