On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Man give im pikin belle, kolet moni from 5 Odas to sleep wit her

49 year old Amoda Bola, give im pikin belle, kolet money from five men to sleep wit di daughter.

49 year old Amoda Bola, give im pikin belle, kolet money from five men to sleep wit di daughter.

49 year old Amoda Bola, dey for police net sake of say e give im 14 year old pikin belle, kolet money from five men to sleep wit di daughter. 

According to Ogun State Police Command, dem say di suspect dey stay for Idi Oro street, Ode Remo, dem arrest am after di daughter report am for Ode Remo divisional headquarters for Remo North LGA. Police tok tok pesin , Abimbola Oyeyemi, tok say di girl mother don separate from di father, and di father turn di daughter to prostitute. Oyeyemi tok say dem don take di girl go state hospital for Isara Remo, and dem don confirm say di girl don get belle. Wetin go shock u most be say di five men wey di father kolet moni from make dem sleep with im pikin, dem be 69,50,50,48 and 30 years. Ogun police don transfer di suspect dem go Anti-Human Trafficking and Child Labour Unit of di state CID.

How u see di mata? #chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C