On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Lekki Port Don Create 153-Capacity Truck Park

Di Lekki Deep Sea Port management don create 153-capacity pre-gate truck park wey go make sure say traffic management control go dey di port.

Di management of di port bin come out tok dis one for dia official Twitter page on Monday.

E tok say di inside part of di automatic gate system get pre gate truck park of 2.5 hectares.

E still tok say di port dey join bodi with di Lagos State government and Nigerian Ports Authority (NPA) to make sure say di traffic management plan go tanda well for di Lekki Economic Zone Area.

Di port management tok say di port gates go get camera recognition for eye wey go read di Radio Frequency Identification (RFID) tags wey go dey di trucks as dem dey reach di port.

E go still get biometric readers for drivers dem, gate kiosks wey go give pick up and drop off tickets to drivers dem and gate men wey go dey allow access and exit for di trucks dem.

E still add say e go get Vehicle Booking System and electronic platform for di pipo wey dey use di port to register wen dem plan to visit di port.

Di Lekki Deep Sea Port na di largest for Nigeria and na one of di biggest for West Africa.  


How una see di mata?
#chookmouth  


 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C