On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Lagos State Sell Moto Of People Wey No Follow Traffic Law

Tears flow as the Lagos State Taskforce and Lagos State Ministry of Justice join bodi take sell 134 moto wey pipu leave anyhow for roads and the one wey dem catch no dey follow traffic law.

This one happen yesterday for the taskforce compound for Alausa, Ikeja.

 

Plenty pipu come out yesterday to come buy the moto for the selling wey dem do. Some of the moto wey dem sell dem catch dem drive one way, others dey use dia moto block road for different part of the state.

Chairman of the Lagos State Taskforce, Shola Jejeloye, tok say on top the mata dem no just sell the moto like that. Dem first carry the moto enta Mobile Court wey come give the judgement say make dem sell the moto.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C