On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Lagos State Deputy Governor Deny Say Eim deny Him Nigerian Citizenship.

Lagos Deputy Governor Hamzat tok say na lie, eim no tok say eim no be Nigerian.

Di Lagos State Deputy Governor, Obafemi Hamzat come out tok say di story wey tok say eim renounce eim Nigerian cittizenship say na lie.

According to di statemenet wey di deputy governor media offfice brng come out, Hamzat tok say all dat tori na lie.

For di Lagos Governorship Petitions last week Thursday, one US immigration lawyer, Olubusayo Fasidi bin tell di court say Hamzat bin take oath of allegiance for US.

According to di witness, person go need to renounce allegiance to eim country of  origin before eim go fit swear Oath of Allegiance to di US and she tok say dis one, di deputy governor do am.

Hamzat media office come tok say di reports wey come out no be wetin really  happen for di tribunal.

Di statement from Hamzat office still add say di documents wey di witness show as evidence na blank documents wey dem download from di official website of di US Embassy.

How una see di mata?
#chookmouth 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 32°C | Low: 26°C