On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Lagos: Police don confam say two pipo die for di accident wey happen for Ago Palace Way.

Di Police Command for Lagos State don yan say two pipo, including one woman wey dey pregnant, die for di accident wey shele for Ago Palace Way, Okota area on Tuesday.

Di spokesperson for di command, SP Benjamin Hundeyin, don confam dis tori to di News Agency of Nigeria (NAN) for Lagos.

"One pregnant woman and one Keke driver die for di accident," e talk.

Hundeyin yan say three other people, including one police officer, dey for hospital dey receive treatment but e no yan di name of di hospital.

E say di police officer wey dey work with Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) team, dem beat am well-well as di crowd vex and dem carry am run go hospital.

"Di crowd attack di hospital and dem carry di police officer wey injure go another place for treatment and make e dey safe," e talk.

Di spokesperson talk say dem never arrest anybody but di command don start investigation about di matter.

NAN talk say di accident happen wen one police officer and LASTMA official wan try control di steering of one Sienna car from di driver.

Dem talk say di accident happen for Wale Street, Balogun Bus Stop, Ago Palace Way, Okota, as di police officer drag di steering with di driver wey no gree stop.

"I see as di officer dey drag di car steering with di driver wey no gree stop. E drag am reach wen di car jam one Keke driver wey carry one pregnant woman and her two pikin.

"Na so di woman, her two pikin, and di Keke driver die for dis matter dis morning. Di car scatter dem and some other police officers come rush reach di place and start dey shoot anyhow," one eyewitness yan.

Meanwhile, LASTMA talk for one statement say di accident happen wen one car driver wey dem catch for driving one-way try run.

Di LASTMA spokesperson, Mr. Adebayo Taofiq, talk say one Keke driver and one pregnant woman die for di accident while two school pikin wound.

Taofiq talk say one traffic officer wey dey for di area, Mr. Hassan Kehinde, wey lead di patrol team, yan say one driver of one blue Toyota Sienna car, wey get registration number AKD 944 HN, dem catch am as e dey drive one-way around Ago Palace Way.

E talk say one police officer wey dey di patrol team, volunteer to escort di car wey dem catch go LASTMA office so dem go fit book am well.

"On dia way and as di car driver wan run, e come divert enter Bayo Oyewale Street, Ago Roundabout, and e jam one fully loaded Keke.

"While di Keke driver die instantly, di pregnant woman die later for hospital. Di two school pikin wey wound dey for intensive care dey receive treatment," e talk.

Di LASTMA spokesperson talk say di police officer wey dey escort di car wey break di law, e too wound for di accident.

E yan say di accident cause people to vex, and dem start dey protest. As di people vex, dem begin beat di escort police officer, but police from Ago/Okota/Ilasa Stations come quick intervene and save di police officer from being lynched.

E add say dem also invade LASTMA yard and damage property, including cars wey dey inside di place. (NAN)

 

How u see di mata? 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C