On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Lagos Government Go Do Waterfronts Make Detty December Sweet

Lagos State government talk say dem don start work to repair some waterfronts and jetty make pipo for fit enjoy Detty December well well.

Di government office wey dey handle water mata for Lagos don talk say dem don start work for some areas. Dem talk say dem go soon face Bariga jetty make e turn correct fish market.

Dia mind na say all dis moves go make water transport go well for pipo wey wan flex and do biznes.

Dayo Alebiosu, di oga for Lagos waterfront mata, yan say di work na to make Lagos tourism sweet. E talk say, “Pipo dey lap Lagos wella for December. Our waterfront must to represent, based on wetin pipo dey see for oda places for di world, like Scandinavia and Palm Jumeirah.”

Alebiosu come talk say government get plan to do wetin oyibo dey call boardwalk for Wole Olateju waterfront. E even talk say government go make sure say pipo no reason to build house for some kind place so that the water go fit move well.

Lagos government go join hand with LAGFERRY, Ministry of Transportation, and some biznes pipo make dem for fit run dis tin well.

Giwa Gardens, one of di biznes pipo wey dem and government go join body run dis package, don promise to dash 100,000 tickets to pipo once everywhere don set.

Givernment don advice Lagosians make dem do normal for road when work start, so that traffic no go sup.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 31°C | Low: 26°C