On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Lagos Don Confirm Mass Burial For #EndSARS Victims

Di Lagos state government wan do burial for 103 victims #EndSARS protest for 2020.

On top dis mata, one memo leak wey tok say dem don approve over N61 million for di mass burial of 103 victims of di 2020 EndSars protest. Dis memo bin tok say e come form Lagos State Government.

Na 19th of July be di date wey dey di memo and na di Director General of di Lagos State Public Procurement Agency, Onafowote Idowu sign di memo. Na one Lagos based Funeral company dem give di contract.

Meanwhile, di Lagos state Government don confirm di memo wey leak but dem dey accuse di pipo wey carry dis tori say dem dey no dey give di pipo di correct informate so e go make pipo vex for di Lagos state Government. 


Di Permanent Secretary of di Ministry of Health, Olusegun Ogboye drop one statement wey tok say di bodies wey dem wan bury na from after #Endsars for Fagba, Ketu, Ikorodu, Orile, Ajegunle and Ajah area for Lagos and no be from Lekki toll gate.

According to Olusegun Ogboye ,dem no carry anybodi from Lekki toll gate.

E say di bodies be unclaimed victims and to reduce di bodies wey dey di state mortuary, dem follow very carful medical and legal guidelines.

Di Permanent Secretary, Olusegun Ogboye tok say after almost three years, nobody don come claim di bodies

How una see di mata?
#chookmouth


 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C