On Air Now

Our Backyard

9:00am - 11:00am

Lagos Don Begin New Measures to Monitor Ebola Disease

Lagos State Government don increase surveillance and preparation to tackle disease following confirmation of one Ebola Bundibugyo virus case wey dem bring enter Abuja from another place.

Di state government talk say dem never record any suspected Ebola case for Lagos. Dem dey urge residents make dem no panic, but make dem dey careful and report quickly if dem suspect say dem don come in contact with di virus.

Lagos State Ministry of Health talk say dem dey strengthen how dem dey monitor disease and create public awareness. Dem also dey work with airport authorities and Port Health Services for Murtala Muhammed International Airport to improve how dem dey screen passengers and respond to emergency.

Dem don advise residents make dem watch out for symptoms like fever, serious weakness, headache, muscle pain, vomiting and diarrhoea.

According to di ministry, symptoms fit show between two and 21 days after person don come in contact with di virus. For di beginning, e fit look like malaria.

Government don urge residents make dem dey wash hand regularly, avoid contact with body fluids of people wey dey sick, and seek medical advice if dem suspect say dem don come in contact with di virus.

Residents fit report any concern through Lagos emergency numbers 112 and 767, or contact di Ministry of Health Directorate of Epidemiology, Biosecurity and Global Health for 0802 316 9485.

Comments

Add a comment

Today's Weather

  • Lagos

    Light rain

    High: 31°C | Low: 25°C