On Air Now

Market Runz

11:00am - Noon

Kidnapping For Di Kontri No Follow For Di Way God Tok Say Make We Dey Behave- Tinubu

President Bola Tinubu tok say e no gree with di way kidnapping dey happen di country. E tok say dis kain tin no follow for di way God say make we dey behave.

President Bola Tinubu tok say e no gree with di way kidnapping dey happen di country. E tok say dis kain tin no follow for di way God say make we dey behave. 

E yarn dis one during im meeting with Jam’iyyatu Ansaridden, wey be Islamic group, for Abuja on Tuesday, President Tinubu tok say security pipo dey work well to stop kidnapping. E also yan say dem go soon bring out all the things wey dem need – like money, plans, and policies – to make sure say dem fit give Nigerian youths beta education.

Presido tok say education na di way wey go fit solve di wahala wey dey ground for di country. E tok say, "No weapon fit fight poverty pass learning."

Presido tok say make we begin do special prayers. Make we focus on giving our youths correct education. Kidnapping and banditry no  follow God way. Make we no dey kill each other blood, e bad. And if peace no dey, development no fit happen. Na only for peace area we fit chase poverty comot. We gats work for peace to make our economy shine well.

Di leader of Jam’iyyatu Ansaridden, Sheikh Muhammad Lamine Niass, tok say make di Presido no stop to dey do the things wey him don start. E tok say, dia movement dey known for peace and tolerance, and dem go continue to dey pray for Nigeria make e develop well.

How u see di mata? #chookmouth 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C