On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Jealous Wife Pour Hot Water Ontop Her Husband Female Worker

One Endurance Samuel for Ondo state dey receive treatment for hospital from di hot water her oga wife pour am.

Esther Godwin pour hot water on Endurance, Say she and her husband dey get affair.
 
Esther tell Endurance make she come her shop to kolet keg of palm oil her husband dey owe am, when Endurance reach her shop na so she pour hot water for her body.

Endurance and Esther husband tell police say dem no get any affair together. 

How u see di mata? #chookmouth 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C