On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

JAMB Don Accuse Di UTME ‘Highest Scorer’ of Changing Result

Di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) don tok say one Ejikeme Mmesoma change her score con dey tok say na she get di highest score for di 2023 tertiary examination dis year.

According to JAMB, Mmesoma wey come from Anambra State don change her score to get one #3 million scholarship from Innoson Motors and bin don dey ready to get recognition from Anambra state Government before dem expose am.

Dis Miss Ejikeme Joy Mmesoma wey tok say she score 362 fro di 2023 UTME and she get #3 million scholarship by Chief (Dr.) Innocent Chukwuma. She bin don almost collect beta recognition by di Anambra State government wen one official contact JAMB to verify only to see say Miss Ejikeme Joy Mmesoma score 249 instead of di 362 wey she first tok.  Di board tok say "She purposely manipulate her UTME result to do pipu wayo and to use mago mago collect scholarship and oda recognition".

JAMB don tok say dem go hold di girl and withdraw her original result.

Still on top dis mata, di board still catch another wayo pesin wey tok say eim score 380 for 2023 UTME. Dis pesin wey eim name na Atung Gerald for Kaduna , d board conn talk say d boy no even write the exam .

From wetin d board tok dem say, Atung no even complete di  application form for  di 2023 UTME, tok less of say eim write di exam.

How una see di mata?

#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C