The Independent National Electoral Commission (INEC) don begin the checking of im rules for political parties as part of preparation for 2027 general election.
For one statement, the commission talk say dem don launch “comprehensive review of Regulations and Guidelines for Political Parties” make e align with the new Electoral Act 2026 wey dem just pass. INEC yan say the move na to strengthen Nigeria election integrity before next national election. INEC Chairman, Prof. Joash Ojo Amupitan, SANna him lead the review, and e get national commissioners, directors, legal experts, and election administrators wey follow join body. According to the commission, the technical team dey check clause-by-clause the 2022 regulatory framework to make sure say e follow all law for Electoral Act 2026 and make party operations dey clear. INEC explain say the new Electoral Act get reforms wey affect candidate nomination, party administration, compliance rules, and how to settle dispute. Dem talk say if dem align regulations early, e go help avoid legal wahala and reduce pre-election fight. The commission still yan about problems wey dey always happen for past elections, like shady party primaries, membership wahala, weak financial reporting, and small participation of women, youth, and disabled people. To solve these, INEC talk say dem go put clear compliance rules and measurable standards for ground. Dem dey also use findings from Political Party Performance Index to guide the reforms. Draft of the Revised Regulations and Guidelines (2026 Edition) go first dey checked internally before dem consult political parties. INEC talk say this reform show their commitment to proactive election management before 2027 elections.