On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

"I Go Show Face" – Natasha Akpoti Don Beat Chest Say She Go Resume For Senate On Tuesday

Senator Natasha Akpoti-Uduaghan don yan say she go return go Senate on Tuesday, afta dem suspend her for more than four months. She talk dis one for her hometown for Kogi on Saturday.

Di Senator wey dey represent Kogi Central say na based on di judgment wey one Federal High Court for Abuja give, wey talk say make Senate recall her from di suspension.

But Senate President, Godswill Akpabio, no gree — him don carry di mata go Court of Appeal for Abuja.

Natasha still talk say she don write letter give Senate to inform dem say she go resume on Tuesday, 22nd of July 2025.

“I get like two months remain before di six months suspension expire. But I don still write Senate again to tell dem say I dey resume on di 22nd, wey be Tuesday, by God grace.

“I go show face, because na court give di decision. Some people dey argue say na order, others say no be order — but wetin important be say na court decision,” she talk.

She still explain say even though she no dey inside Senate chamber, she no stop to dey work for her people.

“Every senator get three main work,” she talk. “Legislative work – to make law and review treaties. Oversight – to monitor ministries and agencies. And representation – and na that one I dey do full ground.

“I dey identify wetin dey worry my people, and I dey push make dem include am for federal budget. I no fit raise bill for now, but I still dey do my job well-well.”

Make una remember say Senate suspend Akpoti-Uduaghan on March 6, 2025, afta she accuse Senate President Akpabio of sexual harassment.

Senate talk say she break their rules, na why dem suspend her. But she carry di mata go court go challenge am.


Today's Weather

  • Lagos

    Heavy rain shower

    High: 28°C | Low: 24°C