On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Gunmen Don Kill Traditional Ruler For Ebonyi State

Gunmen wey pipo dey feel say na politicians send don kill di traditional ruler of Umuezeokaoha Community for Ezza North LGA of Ebonyi State, Ezeogo Igboke Ewa.

Dem tok say di gunmen attack di king palace on Sunday night, come shoot and kill am.

Di Governor of di state, wey be David Umahi don confirm dis bad news wey happen for one tok tok wey di State Commissioner for Information and State Orientation, Barrister Uchenna Orji sign. 

For di tok, wey Umahi tok, him don send di whole security agencies for Ebonyi State to enter action for Ezza North to save and protect dem from any danger.

As di Governor tok, dem must search everywhere to find di pipo wey kill di traditional ruler, as him swear say dey must face di music of deir wicked act as soon as dem find dem. And anybody wey get hand for di killing of His Highness, dem must arrest am.

Umahi still beg all di leaders of di state and di candidates wey no accept di result of di election to send deir resquests go INEC or make dem send am to di security agencies, instead make dem dey tok bad things wey go fit cause wahala for Ebonyi.

And for one statement report wey dem give, di statement tok say, ''dem bring am to di notice of Ebonyi State Governor, say na on Sunday evening wey be 26th of February, 2023, na im dem shoot and kill di Chairman of Ezza Traditional rulers council, His Majesty Eze Igboke Ewa and pipo dey tok say na politician bad boys na him shoot am, becos say him no support one particular party,”.

Di Governor tok say, him know say some pipo wey be candidates don dey tok anyhow about di election results for Ebonyi State and dis tok fit cause wahala and him tok say no position for dis life worth make dem take another persin life.

His Excellency, di Governor say him go catch anybody wey dey do press conferences or social media video to take ginger di pipo for di state to cause wahala.

Di Governor dey beg Ebonyi pipo especially deir youths, say make dem no allow make dem use dem take di life of another persin.

''Abeg we no get any other option than to maintain peace for Ebonyi State'', he tok.

#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C