On Air Now

Club Wazobia

10:30pm - 1:00am

Govt No Fit Dey Pay For University Education- Buhari

President Muhammadu Buhari don tok say goverment alone no fit be dey spend money to maintain University for we countri.

Because if dem continu like that time go reach wen dem fit no get money again to fit pay for am.

Eim yarn this one as eim enta National Assembly this Friday to give the 2023 budget. Presido come yarn say the money wey the countri dey spend ontop University dey too much and e go make sense wey goverment dey pay some part and pipu dey pay the rest.

Even though Federal Government and ASUU still dey drag dia matter for court, oga Buhari tok say. Federal Goverment still dey promise say the agreement wey dem get with the staff union dem go try dia best to do am, even as money no too dey ground. And naim eim make dem no wan sign any agreement wey dem know say dem no go fit do.

Anoda place wey eim chook mouth on top na on top the mata of health sector. Eim yarn say Goverment go try make sure say the hospitals wey we get for the countri get the equipment wey e need to be world standard, and dem go try to jinja the mata of medicines/vaccines production for Naija here.
 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C