On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

GOV Sanwo-Olu Don Reduces Bus Fare By 50 Percent

Governor of Lagos State, Babajide Sanwo-Olu don tok say the state go reduce transport fare for all state transport system (BRT, LAGBUS, and e.t.c) by 50 per cent.

Eim say this one go help reduce the hardship wey the petrol subsidy for inside Lagos.

The Governor yarn this one on Monday for the Lagos House, Ikeja, and eim say dem go continue to dey work on other palliatives wey go  make every-every dey go siriri-werere so that hardship no go finish pipu for inside the state.

The 50 percent cut on top the transportation cost go start on Wednesday, August 2, 2023.

Dem also tok say dem dey follow danfo and other transport pipu inside the state tok so that dem go fit see how dem go commot 25percent for dia own price.
 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C