On Air Now

Our Backyard

9:00am - 11:00am

Go Serve For Di State Wey Your Husband Dey: NYSC

NYSC Don Ask Female Married Corps Members To Go Back To Di State Wey Dia Husband Dey Stay

Di National youth Service Corps a.k.a NYSC on Monday don tell married women wey wan serve wey dem post go anoda state wey no be di one wey dia husband dey stay make dem  go change am . 

Na for dia twitter handle dem take talk dis one, for one tweet wey dem title "Attention All 2023 Batch 'A'Stream 2 Married Female PCMs".

For di tweet, dem talk say all di married women Prospective Corps Member(PCMs) wey dem post go anoda state wey no be di one wey dia husband dey stay make dem go report to di NYSC camp wey near dem so dem go fit change am go di state wey dia husband dey stay.

"Dem go need go di camp with all di papers wey go show say dem don marry".     
 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C