On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Fubara, Rainbow Coalition Dey Make Peace After Political Palava

E tok sai peace don begin enter everywhere now, so everybody go get equal treatment and respect...

Magnus Abe, wey be di Chairman of Rainbow Coalition Reconciliation Committee, don tok sai nobody for di coalition go suffer or face wahala because of di political palava wey happen before.

Abe tok dis one after e lead di committee go meet Rivers Governor, Siminalayi Fubara, for Government House, Port Harcourt, on Sunday. Na di second time dem dey meet di governor inside one week.

E tok sai peace don begin enter everywhere now, so everybody go get equal treatment and respect, no matter wetin happen for political side before. E still tok sai di reconciliation waka don dey move well.

APC South-South Publicity Secretary, Dr Samuel Nwanosike, also bin tanku Governor Fubara for openin im door make dem  com sit down togetha and settle dia kata kata like brothers.

Another pesin wey dey support Governor Fubara, Tamunosisi Gogo Jaja, sef tok for di meeting.

APC governorship candidate, Kingsley Chinda, forma Chief of Staff, Edison Ehie, and oda members of di reconciliation committee dey di meeting.

Comments

Add a comment

Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 29°C | Low: 24°C