On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

Fubara Go Break Ground For New Drug Factory For Port Harcourt

Di place na where di state-owned ₦34 billion auto-disable syringe factory bin dey before. Na former Governor Peter Odili start di project...

Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, go today perform di groundbreaking ceremony for Riven Medical Industries Project for Port Harcourt.

Di project na joint work between Rivers State Government and Enbay Pharmaceutical Industries Limited. According to government, di project go help make Rivers State become one major centre for production of medicines and other medical products for Nigeria.

Government tok say di factory go create plenty work opportunities for residents, improve healthcare services and help grow di state economy.

Di ceremony go happen for di Riven Medical Industries site wey dey along East-West Road for Rumuosi, Port Harcourt.

Di place na where di state-owned ₦34 billion auto-disable syringe factory bin dey before. Na former Governor Peter Odili start di project, while former Governor Chibuike Amaechi later carry di expansion waka go front.

Although dem bin project say di syringe factory go provide thousands of jobs and produce over one billion syringes every year, di factory later fall hand as dem abandon am and thief thief people  scatter plenty parts of di facility.

Now, with di new Riven Medical Industries Project, government believe say di state fit bounce back as one important player for healthcare and industrial development.

Government still maintain say di project go hellep strengthen healthcare sector, create more employment and attract fresh investments enter Rivers State.

Comments

Add a comment

Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 29°C | Low: 25°C