On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Former Governor Of Lagos Tok About the Economic Waka For Naija

Akinwunmi Ambode, wey be former governor of Lagos State, yarn for di 2024 Akinjide Adeosun Foundation (AAF) leadership colloquium and award wey dem call "Economic Asphyxiation - Di Wisdom of Authentic Leaders" for Lagos.

Di former governor tok say make dem no blame President Tinubu hand because e don show say e dey ready to fix Nigeria's economic wahala.

"Dis palava (wey dey ground now) no get anything to do with di person wey dem dey call Mr. President. But if we no sabi di real matter, we go begin dey play blame game. We need to face di real matter wey dey ground."

"Di main matter be say we don dey tired for dis our way wey we no dey fix our wahala. But now, we get person wey don decide, President Tinubu."

"Until we decide say make we join hand for di common goal wey we call Nigeria, di security palava no go end. All of us fit show support for Mr. President. Make we begin see am from another angle."

Ambode add talk say:

"We suppose think outside di box. We suppose dey provide food for ourselves. When we begin use our head reason our own mata and we fix di wahala wey dey ground for Nigeria, e go better for us."

Ambode still talk say no matter how di followers weak, Nigerian leaders suppose dey strong and dey show confidence say tomorrow go better.


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C