On Air Now

Inside Life

2:45pm - 3:15pm

FIFA Women's World Cup: James Don Get Two-Match Ban for Di Alozie Stamp

Di Federation of International Football Association (FIFA) don knack England dia Round of 16 clash with Nigeria for Brisbane on Monday. Di Federation of International Football Association (FIFA) don knack England dia Round of 16 clash with Nigeria for Brisbane on Monday.

Di Super Falcons lose 4-2 by penalties to di Lionesses but one England player na eim full headline as shw collect Red card for di 87th minute wen she match Michelle Alozie for back wen she dey ground.

Di Referee Melissa Borjas bin first give yellow card but come upgrade am to red card afta VAR check di mata.

Di 21-year-old go miss di quarter-final match with Colombia on Saturday for Sydney and still miss di semi-final match with France or Australia if dem go fit beat South Africa.

James don tell Alozie sorry on top social media and dat one calm pipo down.

Alozie come reply say, "All my love and respect to you. I dey sorry for wetin happen".

Di England team still release official statement say "Lauren dey very sorry for di tins wey she do, no be so she dey behave normally".

How you see di mata?
#chookmouth 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 25°C