On Air Now

Football Republik

2:00pm - 8:00pm

FG Say No Be True Say New Terror Group Dey Naija

Federal Government (FG) don talk say no new terror group dey for Nigeria. Dem tok dis one on Wednesday afta di Turkish government yan say one terrorist group wey dem call Fethullah Terrorist Organisation (FETO) dey operate for Naija, and other countries too.

Di Turkish Ambassador wey dem send come Nigeria, Mehmet Poroy, even talk say di group dey use schools and health centres take hide dia operation.

Poroy talk dis one on Tuesday night for Abuja, during one dinner wey di Turkish Embassy organise to celebrate dia Democracy and National Unity Day.

Him talk say:

“To allow such group stay for any country na serious threat.

Sadly, dis FETO people still dey active for Nigeria, especially for school and hospital matter.

We dey always tell our Nigerian friends say make dem shine dia eye well-well and understand how dangerous dis group be.”

But for interview wey The PUNCH do with Maj Gen Adamu Laka, wey be di National Counter-Terrorism Centre coordinator, he clear air say make Nigerians no fear.

Him talk say:

“No new terrorist group dey Nigeria.

No need to panic at all,”

Dem say FETO get link with one Turkish cleric wey dem call Fethullah Gulen, wey die for 2024 at age 83.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 29°C | Low: 25°C