On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

FG go Close One Section of Eko Bridge for 40 Days

Di federal government on Thursday announce say dem go close di Alaka-Costain-Iganmu section of Eko Bridge for another 40 days.

On behalf of di Permanent Secretary of di Federal Ministry of Works and Housing,  Federal Controller of Works, Lagos State, Engr. (Mrs.) O.I. Kesha,tok say di closure go start from Sunday23rd of July 2023.

According to di statement, "dis one dey happen becos of some parts of di bridge wey don spoil and urgent work need to start on top am"

He still tok for di statement  say "make we still know say any delay again on top to repair di part of di bridge go affect di rest part and di badness wey fit happen if dat one happen go bad well well".

How you see di mata?
#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C