On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

FG Don Tok Say Make Universities Close For Election

Federal government don tell universities across di country to close for three weeks so students fit join inside di elections wey dey come.

Inside a letter wey be for dem Vice-chancellors and Directors of inter-university centers, the Deputy Executive Secretary (Administration) of the National Universities Commission (NUC), Chris Maiyaki don yarn say di letter na from an order by Adamu Adamu wey be di  the Minister of Education.

According to Maiyaki, him say all universities for Naija go shut from February 22 to March 14 so students fit follow join for the general election.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C