On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

FG Don Pause Di Remove of Petrol Subsidy

Di National Economic Council (NEC) announce on Thursday for Abuja say im don decide to delay di remove of petrol subsidy wey dem bin plan for June 2023.

Di Minister of Finance, Budget and National Planning , Zainab Ahmed, tok dis one wen she get sidon discuss with State House pipo, wey Vice President Yemi Osibanjo bin head for di Council Chambers for di Presidential Villa.

Ahmed tok say di council don gree say dem need to still tok di mata well well, say di fedral government, states and representatives of di administration wey wan enta need to ready well well before dem comot di subsidy.

She still tok say di comot of di subsidy e dey necessary becos government no fit pay for am again.

On top dat one, she tok say dem need to reduce di weight of the subsidy wey dem wan comot for di pipo of Nigeria.

Di minister still add say di FG go work with representative of di states between now and June 2023 to plan for oda ways wey go help with di fuel subsidy.

She still remind di join bodi say di budget for 2023 get provision for di fuel subsidy reach only June 2023 and di Petroleum Industry Act go comot all di regulations wey dey all di products of petrol 18 months afta di date of di PMS removal wey still reach June 2023. 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C