On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

FG Don Increase School Fees of Unity Colleges From ₦45000 to ₦100000

Di Federal Government through di Federal Ministry of Education don increase di school fees for new students wey wan enter Federal Unity Colleges, a.k.a Federal Government Colleges.

Dis one dey di circular with reference number ADF/120/DSSE/I on di 25th May 2023.

Dem title di circular "Approved fees/charges for Federal Unity Colleges (1st Term) for new students,"wey di Director of Senior Secondary Education, Haija Binta Abdulkadir sign. Di Circular tok say new students go dey pay #100,000 as dem increase am from di former one wey be #45,000.

Di increase go affect almost all di activities for di schools dem, school fees and boarding fees , uniform , text books, deposit, exercise books, prospectus, caution fee, ID card, stationery, clubs and societies, sports, extra lesson, insurance, e.t.c

How una see di mata?
#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 25°C