On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

FG Don Dey Ready To Dey Deliver Nigerian Passports.

FG go dey carry Nigerian passports go dey give pipo house.

Di Minister of Interior, Rauf Aregbesola don tok dis one say FG don start work to see as dem fit go dey do home delivery of Nigerian Passports. 

FG tok say dem go dey work with di Nigerian Postal Service to make sure say dis one go happen smoothly.

Di Minister, Rauf Aregbesola tok dis one wen dem do di official opening of di Immigration Service Passport Front Desk Office for Auchi, Edo state. 

Him still tok say, anybodi wey wan get passport as e dey very important make every citizen fit get dia passports quick quick without stress and with shikini moni

How una see di mata?

#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 34°C | Low: 28°C