On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Fake Result: Mmesoma Don Gree Say She Change Her Result - Anambra Panel

Di panel wey Governor Charles Soludo of Anambra State set up to investigate di examination fraud wey Mmesoma Ejikeme, a candidate in the 2023 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) dey inside, Mmesoma Ejikeme, don submit di report.

Dis report confirm say she manipulate her jamb result , she give herself 362 instead of her real score of 249.

Di Committee for dia eight page report tok say di student of Anglican Girls Secondary School for Nnewi gree say she change her result with her phone.

Wen JAMB release di results for May, Na Mmesoma bin di highest scorer for di exam with score of 362. Dis one bin give am schorlarship wey worth #3 million from Innocent Chukuma,Chairman of Innoson Vehicle Manufacturing.

Jamb later come out tok say Mmesoma no be highest scorer for 2023 UTME. Dem tok say she forge dat result wey she carry, say her real score na 249 no be 362.

Becos of dis one, Anambra state Governor, Governor Chukuma Soludo set up committee wey go chook eye for inside di mata.

Na Anambra state Commissioner of information, Paul Nwosu and together dem do interviews with all di pipo wey dey inside di mata;Mmesoma,JAMB officials, di principal of Anglican Girls Secondary School and oda pipo wey follow dey inside di mata.

Wen di committee do dia report, JAMB tok say Mmesoma bin check her result plenti times and na 249 be di score wey she see everi time.

For dis time wey dem dey chook eye, Mmesoma gree for di presence of her principal and di Education Secretary, say wetin JAMB tok na true be everitin. 

Becos of everitin wey di committee see for di chook eye wey dem do, Mmesoma go write apology to JAMB, di Anglican Girls Secondary School, and di Anambra State government.   

How una see di mata?
#chookmouth
 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 32°C | Low: 26°C