On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Elon Musk Don Announce Audio and Video Calls on top X, Wey e Dey Call Twitter Before

Elon Musk, Di Man wey get X (Twitter before before), announce on Thursday say di social media platform go soon get new feature for video and audio calls.

Musk tweet say "Video & audio calls dey come X.  E dey work on iOS, Android, Mac & PC. You no need phone number. X be di  global address book wey correct well well. Dis new factors no dey anywhere else."

Musk tok say dis feature go work for iOS, Andriod, Mac and PCs.

For early August, Musk announce say him don add live strean feature to X as him post video of himself.

Musk bin also don complete him acqisition of Twitter for October 2022.

He bin dye act as chief executive officer(CEO) of X(twitter before before) until him step down for June 2023 and na Lina Yaccarino replace am.

How una see di mata?
#chookmouth
 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C