On Air Now

You & Yaw

9:00am - 11:00am

Electricity Don Kill One Man Wen Him Dey Try Thief Transformer Cables

One man wey we never know wo e be bin die by electricity wen e dey try thief transformer cables for early momo on Friday inside the compound of di Niger State Printing Press inside Minna.

Di News Agency of Nigeria (NAN) report say na some of di staff of di printing press find di dead bodi of di man for where e dey hang on top di transformer on Friday morning.

Di Head of Legal Unit of di Abuja Electricity Distribution Company (AEDC), Aminu Ubandoma, confirm dis one to tori people.

He tok say di company bin don dey  get different reports of pipo wey dey go dey spoil and destroy transformers dem.

He still tok say di company dey work with security agencies, especially with di police, to make sure di rate of dis badness stop or e reduce.

Di tok tok person of di Niger Police Command, DSP Wasiu Abiodun,tok say around dat 11:00 a.m. on Friday,dem get report of say pesin dey try spoil/thief electricity property dem. He tok say dis incident happen for around di old secretariat area for di printing press compound where dem see di dead body of one male adult,wey dem never identify, for near one transformer with cable cutter and some cables wey dem don cut.

Dem dey suspect say na electricity kill am.
Abiodun say dem don carry di bodi go di General Hospital, Minna by Morris patrol team and dem confirm am for hospital say e don die.

He still tok say di security join bodis dem dey try to find di relative of di man as dem still dey investigate di mata with AEDC.(NAN)

How una see di mata?
#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C