On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Eid-Ul-Mawlid: Federal Government Don Declare Friday as Public Holiday

Federal Government don declare Friday, September 5, public holiday to mark Eid-ul-Mawlid celebration.

Minister of Interior, Dr. Olubunmi Tunji-Ojo, na im announce di public holiday on top Federal Government behalf inside one statement wey Permanent Secretary, Dr. Magdalene Ajani, sign on Wednesday for Abuja.

Dr. Tunji-Ojo still advise Muslim faithful make dem reason about di values of peace, love, humility, tolerance and compassion wey Holy Prophet Muhammad show example.

E still talk say na dis kain values fit help build better, united, prosperous and progressive nation.


Today's Weather

  • Lagos

    Light rain

    High: 27°C | Low: 23°C