On Air Now

Our Backyard

9:00am - 11:00am

Eid el-Fitr: FG Don Declare April 21st, 24th as Public Holiday

To celebrate dis year Eid el-Fitr,di Federal Government don declare Friday, April 21, and Monday, April 24, 2023, as public holiday.

Di Minister of Interior, Ogbeni Rauf Aregbesola na im tok dis one for one statement wey dem bring come out tru di Permanent Secretary, Dr M.L. Shuaib Belgor, on Wednesday.

For im statement, di minister congratulate all di Muslims for di successful complete of di holy month of Ramadan and still encourage dem to carry the values of kindness, love, tolerance, peace, self-denial, sacrifice and correct neighbor behaviour as di Holy Prophet Muhamad(Peace be upon him).

He still tell Muslims to maintain all di correct tins wey follow di fasting period so dem go be better pipol and correct worshippers. 

How una see dis one ? #chookmouth 
 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C