On Air Now

You & Yaw

9:00am - 11:00am

DSS Dey Claim Say Plot Dey to Mobilize Youths for Violent Protests

Di Department of State Services tok say plans dey by pipo wey dem no go fit call dia name to start violent protests for Nigeria.

Di secret police tok say di aim of di alleged protest na to spoil di work wey federal government and security join bodi dey do for di socio-economic mata for naija.

For one statement on Monday, di DSS spokesperson, Peter Afunanya tok say politicians dem follow for di sponsors to gather student leaders, tribe join bodis, young pipo wey no know wetin dey happen take do di protest.

DSS tok say dem know di ringleaders and dem dey monitor dem but dem no go tok dia name .

For inside di statement, "e dey say di DSS dey tell di public say dem don see plans dem wey some elements for different parts of di country to start protest wey fight go follow am". 

Di DSS dey call all di Vice Chancellors of University and heads of higher institution dem to discourage dia students say make dem no join anytin wey resemble protest. 
 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C