On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Doctors Don Cut One Of Mr Ibu Leg

Nollywood Actor, John Okafor, wey people sabi as Mr. Ibu, don do surgery wey dem comot one of im leg.

Dem yarn ontop Mr Ibu official Instagram page for Monday, 6th November 2023

"For 1 pm,  Daddy don waka through 7 successful surgeries but to keep am alive and get chance make e recover, dem don cut one of im leg.

"Dis tin dey pain us well well but we no get choice dan to gree say na di new way wey Daddy go dey so, so e go fit dey alive.

Di family still dey beg Naija people make dem show support for di actor.

"Abeg, we still dey beg Naija people make dem helep Daddy for dis time wey e dey, e need all di help e fit get.

"Thank you, everybody, di Okafor family dey grateful and we no go forget wetin una do. When time reach, Daddy go personally thank everybody wey helep am during dis time as soon as e dey stable!"


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C