On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

Court Go Keep Seun Kuti For Four More Days

One Chief Magistrates' Court for Sabo-Yaba, Lagos don gree say make dem keep Seun Kuti, the Afrobeat singer for four days extra.

Di order by di Chief Magistrate , Mrs Adeola Olatubosun, on Tuesday bin come after police apply to keep Sun Kuti for extra 21 days make dem investigate wella. 

Olatubosun still shift di case till May 22 say make di prosecutor photocopy di case file and send one copy go di state director of public prosecutions for advice.

Dem arrest Seun on Monday come detain am becos of di video of wen eim bin beat police officer for ontop Third Mainland Bridge.

Police aspart of dia investigation carry go Seun house go search. lagos State Public Relations Officer, Benjamin Hundeyin tok say dem see some kind tins wey no clear na eim make dem go search eim house. Dem charge Senun Kuti for beat wey he beat police officer.   

How una see di mata?

#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 27°C