On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Court Don Hold Skit Maker Trinity Guy

One Magistrate Court for inside Ibadan, Oyo State don order say make skit maker, Abdullahi Maruff Adisa, a.k.a Trinity Guy go prison becos eim allegedly sexualizing minor for one viral skit video.

Di court bin hold the victim papa and mama Isiaka Ahmed, 40, and eim wife, Rofiat,29,on top two-count charge of conspiracy and sexual abuse an dexploitation with di skit maker.

Di Magistrate, Mrs P.O.Adetuyibi, wey no hear di beg wey di defendants' dey beg , she tok say di case file don reach Oyo State Ministry of Justice.

Adetuyibi jail di three defendants for Agodi prison, Ibadan make dem dye wait July 11 wen di case go come up again.

Remember say Nigerian Force Public Relations Officer, Olumuyiwa Adejobi, bin don call for di arrest of di skit maker becos he bin sexualize one female minor for one video clip wey dey trend.

How una see di mata?
#chookmouth      
 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 32°C | Low: 26°C