On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Cooking Gas Don Go Up By 38%

Cooking gas prices don reach #16,250 for 12.5KG cylinder

Di increase in price follow afta 37% increase for di price of 1kg per gas, wey don go up reach #1,300 from #950 for di same period.

According to di latest report from di Nigeria Bureau of Statistics (NBS)for January 2024. For dis report,na 3.55% month-on-month increase na enta di average retail price to refill 5kg cylinder of cooking gas,as e don reach #5,139 wey be #4,952 for December 2023.

Na Nassarawa state get di highest price to refill 5kg cooking gas cylinder for #5,790, Jigawa state carry second with #5,681 and Gombe state for #5,660

Still on still Kaduna state get di lowest price at #4,150, followed by Ogun state and Osun with #4,751 and #4,763.
 
Sabi sabi pipo for di mata don tok say di way wey gas price dey go up go affect di lives of Nigerians as di economy don already hard and e fit increase di wahala of inflation for di whole kontri.

How una see di mata?
#chookmouth 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 26°C