On Air Now

Market Runz

11:00am - Noon

Continu To Dey Use Old 200 Naira Notes Till April 10th - President Buhari

Nigeria's Presido don tok say pipu fit still dey use the old 200-naira notes for the next 60 days starting from February 10th till April 10th.

Presido Buhari tok this one wen eim show ontop television on Thurday morning.

"I don tell CBN(Central Bank Of Nigeria) make dem allow pipu to dey use 200 naira"
eim still tok say make the old 200 naira and new N200, N500 and N1000 banknotes dey go round togeda until April 10 2023.

Presido yarn say why eim tok this one na becos eim dey the hardship wey dey the countri.

On Wednesday, the Supreme Court push the mata wey three state carry come meet dem ontop the February 10 deadline, go Wednesday, the 22nd of February, 2033.

And the oga kpata pata court been don tok say make pipu still the use the old notes.

Many pipu inside some state for we obodo Naija  – Edo, Delta, Oyo – don dey do we no go gree for the mata. As dem no see the new money and pipu no wan collect the old one.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C