On Air Now

Football Republik

2:00pm - 8:00pm

Chatham House: I No Go Do Mago Mago Ontop Insecurity Mata -Peter Obi

Labour Party LP president canditate, Peter Obi talk say him no go take am jeje when he wan put eyes for mata of insecurity wey dey for Country im sit down for president chair.

Eim talk this one on monday for Chatham House wey dey for London,eim talk say 'the wahala you be igbo, you be yoruba, abi hausa dey plenty for our country,and wetin dey make people talk say dem dey do the ojoro',

Obi talk say i go make sure this wahala go stop kpatakpata if country poeple vote am'and him go make everybody joli.


'Borno na still part of country,if i no safe,that one mean say our country no safe be that. So make we no talk say any part we country no follow for we country.

Labour Party flag man, talk say him and his second, Datti Ahmed go make sure no person for this country go dey in any internanally displaced persons'[IDP] camp.


Obi talk say eim go stop poverty wey dey for northern nigeria, him go take land do am, as eim talk say i dey work wala for asset and revenue generation pass oil.
 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 28°C