On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

CBN Go Punish Bank Wey Dey Give Old Naira Note

Central Bank Of Nigeria Don Dey Monitor banks wey dia ATMs still dey give old money and wan show dem pepe them.

De oga kpata kpata for legal service inside CBN,Kofo Sulam-Alada who talk m where them dey make person know wetin dey shele,for computer village market wey dey for Eko on wednesday.

"We don dey beg bank make them come take money for central bank" na wetin eim talk.

"We done check wella, come see say many mago mago wey dey happen inside de bank branch dem, people we no manager dey enter bank go collect the new money wey dey dia na eim make we stop people to dey collect money for counter."

"Na eim make we talk say e go be for ATMs, as eim no no pesin wey be big or small man.

Alada talk again say central bank dey chook dai eyes for all banks wey dey Nigeria and bank wey no put new naira for their ATMs go enter  wahala for dia hand.

Eim talk m again say january 31 na de last day people go use old naira and nothing go make m no happen.

Oga for legal service stil talk to market pipul wey dey dai, say make them hala these numbers- 08176657641, 08176656721, 07080650791 and drop messages for newnaira@cbn.gov.ng wen them get wahala for getting the new naira.

Nigeria done open new N200,N500,N1000 note on wednesday 23 November 2022 as CBN talk finish say 31 janaury 2023 be last people go ues old naira.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C