On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

Catholic Bishops Dey Ask Make People Pray, Repent During Lent

The Catholic Bishop Conference of Nigeria don call Christians and Muslims say make dem use this their fasting period to take pray, repent and allow peace reign for awa country Nigeria.

For one statement wey dem issue after their meeting for Abuja, the bishops talk say e dey important say Lent this year join Ramadan. Dem yan say e no be mistake, na God dey invite us make we work and live together with peace and respect. Dem tell Nigerians to increase their prayer, work out love  run from sin, and repent. Dem still encourage Christians and Muslims make dem contribute to good neighbourliness and make society beta. The bishops explain say “Common Good” mean say make everybody get chance to live dignified life. Dem talk say e mean say make people get food, clothes, health, work, education, peace and security. The talk follow concern insecurity, talk about tragic events wey dey happen like senseless killing, mass burial, endless tears and grief for some parts of awa country. Dem call on government to invest for better surveillance technology and intelligence gathering. Dem warn say if government delay to prosecute terrorists, e go make people think say government dey involved. Dem also condemn illegal mining and economic sabotage, talk say trillions of naira dey lost every year. Dem suggest make dem use drone technology and artificial intelligence (AI) to monitor mining areas. Finally, the bishops yan say, “Better Nigeria fit happen,” and dem beg citizens make dem no give up hope.
 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 32°C | Low: 26°C