On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Bolanle Raheem: Police Officer Drambi Vandi Go Die By Hanging

Lagos State High Court wey dey for Tafawa Balewa Square annex, Igbosere, for Lagos Island, don tok say suspended Assistant Superintendent of Police (ASP) wey dem call Vandi.

dey guilty of murder and dem don sentence am to death by hanging. As e be say eim kill Lagos-based lawyer wey dem call Mrs Omobolanle Raheem.

Justice Ibironke Harrison tok say the Lagos State Government don show dem beta proof say Vandi dey guilty, and the court no get any reason to fit doubt again.

The judge talk say, "Court don see say this person wey dem call defendant guilty for one count of murder. Dem go hang am for neck until eim die."

Na on January 16, the Lagos State Government carry Vandi go court come tell court say eim shoot and kill the 41-year-old lawyer wey carry belle for Ajah underbridge checkpoint for December 25, 2022.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 25°C