On Air Now

Music

Midnight - 6:00am

Beta Drama Shele Inside OLD TRAFFORD As MAN U Give LIVERPOOL Gbas-Gbos On Top FA QUARTERFINAL

Manchester United climb okada, vex knack Liverpool 4-3 for di FA Cup quarter-final wey burst football fans dem brain inside Old Trafford on Sunday, March 17 2024, as Amad Diallo score di winning goal for di 120th minute to pour sand inside Jurgen Klopp and eim boys dem garri as dem dey dream to win the quadruple this season.

Diallo score one kind ‘na only me waka come’ goal for di dying minutes - and eim come chop red card sake of say eim comot him jersey to celebrate the goal. Remember say eim don collect one yellow card for inside di game before.

Na dat him goal carry United waka go Wembley lai dis, as dem record wey don pass 100 years tanda gidigba say dem never chop am for Liverpool hand for inside Old Trafford ontop any mata wey be FA. 

Liverpool bin dey few minutes from di semi-finals, for wetin be Klopp’s final season for Anfield, but Marcus Rashford tell am say no be so, as e go score for di 112th minute for inside extra time, before Diallo burst net with hin goal wey wear beta cap for head.

 United go play against Coventry City for the semi-finals, while di FA Cup draw give di defending champion Manchester City one date for Wembley with Chelsea.

 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C