On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Big Brother Housemate Don Beg For Him Yama Yama Tok.

Big Brother Housemate Seyi Awolowo don beg again for eim yama yama tok afta dem evict am wit four housemates on Sunday.

Two weeks ago dem catch Seyi for camera wey eim dey tok to eim fellow housemates wey eim dey support sexual violence and harassment.
This tin cos wahala wit many people so tey Lagos State Domestic and Sexual Agency, no dey happy with di Big Brother housemate.
Lagos State Domestic and Sexual Agency tok say dat kain statement dey very bad and e dey cause culture of violence and abuse.
Afta eim eviction on Sunday Seyi take time to apologise say e tok out of line and eim beg for forgiveness.

 

How u see di mata?

#chookmouth 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C