On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Benue PDP Don Pursue Ayu Because Of ''Anti-Party Activities”

Peoples Democratic Party (PDP) for Igyorov ward wey dey Benue state don pursue di party national chairman, Iyorchia Ayu, because say dey tok say him go dey do things wey dey against deir party.

Twelve executive members for di ward wey dey Gboko Local Government Area tok say Ayu follow cause make dem party no win for di 2023 general election.

“We wey gather here, we be ward executive members of Igyorov ward, Gboko local government,” and dis letter from our executives tok say, as we don chook eyes for everything wey happen for di Presidential elections and National Assembly elections wey dem do for February 25 and even di Governorship and State House of Assembly elections wey dem do for March 18 2023, wetin we see pain us because say, Iyorchia Ayu, wey be di  National Chairman of di Peoples Democratic Party (PDP), work against us, come cause make we no win for Igyorov council ward.

“E even dey for record say him no pay him yearly contribution money wey dey under section 8 subsection 9 of the constitution of the Peoples Democratic Party (PDP) as dem rearrange for 2017.

As we continue to chook eyes for di matter, we see say him no vote when dem dey do di governorship and state assembly elections wey happen for March 18 and almost all of him close friends dey work for di party wey dey drag seat with us, All Progressive Congress (APC), and na dis one cause di poor performance wey PDP get for Igyorov ward.

“With all dis one wey we don happen, all of us don gather gree say we no fit trust Dr. Iyorchia Ayu and we don pursue am as a member of our party as e dey hot. And dis pursue don dey official from March 24, 2023,” dem tok.

Dis one happen days after di PDP National Working Committee (NWC) wey Ayu lead, carry Benue State governor, Samuel Ortom, go meet disciplinary committee for anti-party activities.

#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C