
Former Minister of Transport and ex-Governor of Rivers State, Rotimi Amaechi, don blow hot say him go block President Bola Tinubu from winning second term for 2027.
Amaechi wey don join African Democratic Congress (ADC), talk say Tinubu government no send Nigerians at all, and na time don reach make people stand up and rescue di country from more wahala.
As him land for Port Harcourt International Airport on Wednesday, Amaechi tell plenty supporters say make dem begin register for ADC sharp sharp.
“This one na to let una know say new party don land. Anybody wey love Rivers and Nigeria suppose join ADC. We go chase this hunger government comot,” Amaechi talk.
“If you never taya for Tinubu, me I don taya. If you no dey hungry, me I dey hungry. Rich man dey spend N4 million every month for light, na only God know how una dey survive,”
“Tinubu say e no come make anybody happy. But ADC come to make people smile again.”
Amaechi also promise say ADC no go do mago-mago for primary election. Anybody wey win, everybody go support am.
“We go do free and fair primary. Anybody wey win, all of us go support am,” him add.
Amaechi come warn say him no go work with anybody wey dey do election result manipulation for Rivers State.
“Rivers people sabi write result, claim say dem win. If you dey with dem, me and you no go work together. Make God bless everybody wey dey ready to do better.”
After him talk, Amaechi follow him people trek from Waterlines reach him house for Old GRA, as residents cheer am for road.