On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Akpabio Don Release Di List of Di New Senate Committee Heads

Senate President Godswill Akpabio on Tuesday announce di heads of some of di committees, like Appropriations, Public Accounts, Ethics, and Public Petitions and Establishment.

Akpabio bin tok dis one for the sit down tok wey dem do on Tuesday. He tok say di chair of di Appropriations Committee go be Senator Solomon Adeola, while di Public Accounts Committee na Senator Ahmed Wadada go head am.

Senator Okechukwu Ezea go collect di chair of di Ethics and Public Petitions Committee and eim deputy go be Senator Khalid Mustapha.

For di Public Accounts Committee na Aliu Wadada Ahmed as Chairman and Onyeka Peter as Deputy Chairman, while Sunday Karimi go be Chairman of di Senate Service and Williams Eteng Jonah as Deputy Chairman.

Oda Special Senate Committee wey di Senate President announce na:
- Rules and Buisness- Titus Zam(Chairman), Opeyemi Bamidele (deputy)
- Legislative Compliance — Garba Musa Maidoki (chairman), Ede Dafinone (deputy)
- Media — Adeyemi Adaramodu (chairman), Salisu Shuaibu Afolabi (deputy)
- Appropriations — Olamilekan Adeola (chairman), Ali Ndume (deputy)

Senate Presido Akpabio bin read di letter wey Presido Tinubu send to di senate to confirm di Service Chiefs wey Presido Tinubu appoint.

According to Senate Presido, di full senate go screen di service chiefs for di senate chambers for date wey dem never tok.

Preisdo Tinubu last week still ask House of Representatives to confirm di new service chiefs wey him appoint.

How una see di mata?
#chookmouth  
 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C